“We Go See” – Crystal Palace Striker Mateta Yarn Wetin E Tell Millwall Goalkeeper After That Wicked Tackle

Crystal Palace striker Jean-Philippe Mateta don yarn wetin e talk for text with Liam Roberts after the Millwall goalkeeper knack am one wicked tackle wey tear e ear bad bad, make dem even sew 25 stitches put.

Earlier dis month, Crystal Palace qualify enter FA Cup quarter-finals after dem beat Millwall. But di match wey dem play for fifth round no be wetin fans go forget quick because of Roberts’ rough challenge on Mateta.

For di match wey happen for Selhurst Park, Roberts rush comot hin goal to clear ball, but e con land one kung-fu kick for Mateta head, wey make di striker just lay for ground like say e don faint.

Palace medical team rush come treat am, give am oxygen before dem rush am go hospital. After di whole wahala, di English FA suspend Roberts for six matches.

As e dey give update on how hin body be now, Mateta tell Sky Sports say, “I dey feel good, I dey alright. I remember everything—the kick, how I dey for ground. No be say I get concussion. When e kick me, I just lie down dey wait make e collect red card, I even ready continue di match.”

E still talk say di goalkeeper reach out to am after di match. “E text me while I still dey hospital. I just tell am, ‘No wahala, na football. We go see.’”

Mateta con add say, “E apologize and e really dey concerned. But wetin don happen don happen. I no be goalkeeper, so maybe I no fit see am di way dem go see am. But I feel say e too overdo just because e wan stop me from scoring.”

Posted in Sports, Trending.