Controversial media personality Kemi Olunloyo don reject her family name and distance herself from her papa side – di family of late former Oyo State Governor, Dr. Victor Omololu Olunloyo.
Di former governor wey be beta mathematician and politician die on Sunday, April 6, at di age of 89.
For some videos and posts wey Kemi drop for Facebook and TikTok, she talk say she no dey part of di Olunloyo family again and she no go collect anybody condolence message for her papa death.
She talk say: “I dey upload videos about my papa death for TikTok. I no be part of di Olunloyo family again, and I don talk am since 2024 say I no go ever come back Nigeria, even if my papa or mama die.”
She still add say: “I no dey accept anybody condolence because me sef I no dey condole with anybody.”
Even though she talk say she don forgive her papa, she describe am as two-faced – say di man show one kind image to di public, but e different for inside house.
“You no sabi wetin dey happen for my family, just like I no sabi wetin dey happen for your own. My papa na two different people – one for outside, another one for house. He scatter our family, torture us emotionally and physically, and use me for many things,” she talk.
She still accuse am say e join juju and occult things before he later become born-again Christian.
“My papa dey into juju well well. He dey inside occult things until I call am out for im 80th birthday. Na afta dat one he go meet Pastor E.A. Adeboye say he wan give his life to Christ.”
She also reveal say kasala burst for di family when her papa meet Aderonke Omololu Olunloyo (wey dem know before as Ronke Sonaike) during im 1983 campaign and later marry am. Kemi talk say di relationship break her mama heart and cause serious gbege for di family.
“My mama marry intellectual man wey get PhD at 26, but e later turn polygamist. No be say polygamy bad, but na how everything take happen break our home.”
As at di time dem write this tori, di Olunloyo family never respond publicly to her claims.
Part 1: My father’s death
Victor Omololu Olunloyo
1935-2025#Drkemiolunloyo🇳🇬#Kemitalkslife pic.twitter.com/BFRo550N2R— Dr Olukemi Olunloyo🇳🇬🇺🇸 (@DrKOlunloyo) April 9, 2025