Former Manchester United midfielder Nemanja Matic don call Andre Onana “one of di worst goalkeepers” wey don ever play for di club, as e vex say di goalkeeper talk say Man United “better pass” Lyon.
Ruben Amorim’s Man United wey no dey perform well this season go face Lyon for Europa League quarter-final first leg on Thursday. United dey 13th for Premier League table but dem never lose for Europe this season.
After di goalless Manchester derby on Sunday, Onana yarn say to beat Lyon no go easy, “but I think we are way better than them.”
Dem later ask Matic wetin e think about Onana’s boastful statement, and e reply say:
“You know, I dey respect everybody, but if you go talk like that, you gats back am up with performance.
“If na person like David de Gea, Peter Schmeichel or Edwin van der Sar talk am, I go reason myself. But if na you, wey be one of di worst goalkeepers for Man United history, at least by stats, you suppose calm down first before you dey run mouth. Make we dey look.”