Real Madrid midfielder, Eduardo Camavinga, no go play again for di rest of di season as di club don announce say im get groin injury on Thursday.
Di French international wound during Real Madrid 1-0 win over Getafe for La Liga on Wednesday.
“After di medical test wey our doctors do for Eduardo Camavinga today, we don confirm say im get complete tear for di left adductor tendon,” na wetin Real Madrid talk for statement.
Spanish media dey report say Camavinga go miss di Copa del Rey final against Barcelona wey go happen on Saturday, and also di last five league matches as Madrid dey try catch up with Barca for table.
Reports still talk say Camavinga fit miss di Club World Cup wey go happen for United States dis summer, as dem dey estimate say im recovery go take about three months.
Even though Camavinga never too get steady form this season, di 22-year-old still play important role last season when Madrid win both La Liga and Champions League.