Workers’ Day: Federal Government Don Declare Thursday Public Holiday

Workers’ Day: Federal Government Don Declare Thursday Public Holiday

Federal Government don declare Thursday public holiday to celebrate this year Workers’ Day. Workers’ Day dey happen every year for May 1.

Minister of Interior, Olubunmi Tunji-Ojo, announce am on Tuesday for one statement where he praise Nigerian workers for their hard work and sacrifice.

He talk say di effort of workers dey help Nigeria grow both for inside and outside di country.

Di minister still beg make peace reign so that industrialisation and economic growth fit move forward, and he encourage workers make dem dey do innovative and productive work.

He talk say, “Work get dignity; the way we take put mind and energy for wetin we dey do na part of how we go take build this nation.”

He also talk say this Tinubu government dey fully committed to protect life and property of everybody wey dey inside Nigeria – both Nigerians and foreigners.

As he dey wish workers happy Workers’ Day celebration, di minister beg make Nigerians continue to hold hope strong, say President Bola Tinubu go fulfill im Renewed Hope Agenda.

Tunji-Ojo still ginger workers make dem improve their skills and handwork, say e go help better governance and make everybody enjoy wetin Nigeria get.

Posted in News, Trending.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *