President Bola Tinubu don officially submit di 2025 budget for Rivers State go National Assembly make dem reason am, afta di Rivers State House of Assembly bin dey under suspension.
For di letter wey e write give Senate President, Senator Godswill Akpabio, di budget wey Tinubu submit na ₦1.481 trillion. Dem wan use di money boost beta sector dem wey go move di state forward.
Infrastructure carry di highest allocation wey be ₦324 billion. Health sector go collect ₦106 billion, and dem don keep ₦5 billion from inside for free malaria medicine. Education go receive ₦75.6 billion, and agriculture dey get ₦31.4 billion.
Di budget focus on how dem go invest well-well for road and building matter, healthcare, school and farming, and dem dey expect say all dis investment go create like 6,000 new job opportunity.
President Tinubu beg make di Senate look into di matter quick-quick. Senate don carry di budget give their Ad-hoc Committee on Emergency Rule make dem check am well and report back sharp-sharp.
Tinubu also write House of Reps to approve di same Rivers budget. E remind dem say di Supreme Court don cancel di previous 2025 budget wey di suspended Governor Siminalayi Fubara bin submit.
No be today di political gbege start for Rivers. Na since Fubara and di House of Assembly members wey dey support Minister of FCT, Nyesom Wike, begin fight. Di wahala make President Tinubu declare state of emergency for Rivers on March 18, 2025.
For di national broadcast wey e do, Tinubu suspend Governor Fubara, Deputy Governor Ngozi Odu, and all di Assembly members for six months.
E come appoint retired Vice Admiral Ibokette Ibas as di administrator wey go run di affairs of di state for di first six months.
Tinubu talk say na Section 305 of di 1999 Constitution give am power to act, say e no fit sidon dey look while di political crisis dey spoil things for Rivers.
Plenty civil society group and activists don condemn di suspension of elected officials. Dem dey call make government return dem back. Some people for Rivers don dey protest for and against di emergency rule, especially women wey don dey come out strong since di announcement.
But for now, di appointed administrator still dey in charge and dey manage all di government matter for di oil-rich state.