Singer Lojay don talk wetin make am believe say Headies award dey more important to Nigerian artists pass Grammy and other big international awards.
E yarn say international award people no dey ever put Nigerian artists first.
As e talk for one recent interview, di Grammy-nominated singer say e important make Nigerian artists value and support awards wey come from Nigeria.
Lojay wey win Best Male Vocal Performance for di 17th Headies talk say:
“As sweet as Grammy and other international awards be, as a Nigerian, you no fit ever be priority for place wey no be your own. We dey beg make dem even put us for Pop category for Grammy for pop songs wey we sing. Tems drop one of di finest R&B album last year, but dem give her Best African Music Performance.
“Why dem no mention her name for R&B, Pop or Best Female category? Na because dem get their own people wey dem believe deserve those awards – and e dey okay like that. But wetin go help me as Nigerian artist na if, for example, Headies become so big say American artist dey win Headies and dey come Naija come collect am. I go like see one day wey Travis Scott go come Nigeria because of Headies.
“I no dey gain anything if Grammy big pass Headies. We wey dey here no dey gain anything. But if Headies blow well, everybody go benefit.
“I believe well well for Nigeria. I believe say Nigeria fit better, I believe say we fit strong, I believe say our people and wetin we dey do fit go worldwide. So make we no dey look down on our own.”