Peter Okoye Don Vex for Him Brothers Because of Royalty Wahala

Peter Okoye Don Vex for Him Brothers Because of Royalty Wahala

Peter Okoye, one of di Psquare duo wey no dey together again, don react to wetin one lawyer talk say he yarn for EFCC na lie full am.

For Instagram, Peter show him vex, say their publicist dey try paint am like person wey dey lie. He talk say he no be May D or Cynthia Morgan wey dem fit silence, say him na Peter Okoye, “the rock/okwute of the Okoyes”, and say na truth go win at last.

Peter even talk about how Mohbad matter touch am, say e don tire to dey always play “the bigger person” for family wahala, and say e no go keep quiet again.

Him words:
“Exactly what I was talking about: their publicist doing everything for me to look like a liar. I am not May D or Cynthia Morgan; I am Peter Okoye, the one and only the rock/okwute of the Okoyes. The truth shall surely prevail.
Una thief Abi Una No Thief.

He add say:
“After watching everything about Mohbad’s death and how the whole thing played out to date, I decided to myself that I would never play the bigger person nor act as the mature one… Simply because I was trying to be the bigger person and act maturely! Omo! Never again. So, love me or hate me, I will continue speaking my truth.
Una Thief Abi Una No Thief. Family Doesn’t Steal From Family.”

Peter still hint say di Psquare reunion for November 2021 na setup wey dem use catch am, and as di matter don enter court, him go wait for better time to talk everything.
“Family Doesn’t Steal From Family. Una Thief Abi Una No Thief.”

 

Posted in Entertainment, Trending.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *