De Federal Government don tok say no be collapsed dam cause de heavy flood for Maiduguri, Borno State.
Instead, de Minister of Water Resources and Sanitation, JOSEPH UTSEV, tok say na too much water from Ngadda River wey overflow de Alau Dam.
UTSEV wey dey brief tori people ontop the matta, tok say Alau Dam for Maiduguri still standa gidigba.
De Minister also throw warning say more flood go happen for southern parts of Naija, particularly in the Niger Delta region, because of plenty rain water wey dey flow enter River Niger and River Benue.