Oga Presido Bola Ahmed Tinubu don enter Maiduguri, Borno State, to go see things for himself sake of di flood disaster in di area.
Di Nigerian Air Force plane wey fly Oga Presido Tinubu touched down for di airport for Maiduguri for afternoon of Monday, as Governor BABAGANA ZULUM and other big men dey wait to welcome him.
From there, President TINUBU go visit de palace of Shehu of Borno, where him promise say government go support people of Borno state to recover from wetin dem loss due to the flood.
Kogi State Governor USMAN ODODO bin also dey for de Palace of the Shehu of Borno, plus de Group Chief Executive Officer of the Nigerian National Petroleum Company Limited, MELE KYARI, among others.
Before now, di Inspector General of Police, Kayode Egbetokun, still go visit the Maiduguri to sympathise with di government and di pipu of Borno state sake of de flood wahala.
IGP Egbetokun used the opportunity to assure de government se dem go rebuild four police stations wey de flood disaster destroy.