Di Lagos State Gorment don tok se di pipu wey di recent fire outbreak for Oko Baba plank market affect dey stay di area illegally.
Di plank market wey fire breakout dey for Ebute Metta area of Lagos State.
Di Commissioner for Information and Strategy, Gbenga Omotoso tok dis one wey him dey react to allegate se di plank merket traders dey blame di gorment for di fire incident.
Gbenga Omotoso tell tori pipu se illegal occupants no gree relocate to di new site wey di state gorment make for dem for Agbowa area for Ikorodu.