De govment for Mali don order to close de airport for de capital, Bamako, after dem hear gunshots and explosions inside military base for the area.
AFP news agency report say dem never identify armed men do de attack for de military police base for Bamako.
As that one happen, na so dem come close some schools for Bamako, just as de United Nations Mission in Mali advise dem workers make dem match their movements.
Remember say Mali na one of three West African countries wey dey under military rule, after soldiers overthrow de elected civilian government for 2020 and 2021.