EFCC say YAHAYA BELLO Still Be Wanted Man, After Fmr Kogi Governor Claim Say Him Don Surrender

De Economic and Financial Crimes Commission don tok say former governor of Kogi State, still be wanted man for N80.2b money laundering.

 

EFCC tok-tok person, DELE OYEWALE say dem never see YAHAYA BELLO dem office Abuja, and de case of money laundering still dey ground.

 

Dis tory burst out after the before governor of Kogi State bin announce say him don surrender to EFCC to defend the fraud charges ontop him head, after him don dey hide for five months, since April 18 when di EFCC declare am wanted.

 

Na di Director of the Yahaya Bello Media Office, Ohiare Micheal, tok sey the former governor decide to show face after him consult with him family, lawyers and political friends.

 

OHIARE MICHAEL tok sey some Nigerians bigmen, plus Governor Usman Ododo of Kogi State, follow YAHAYA BELLO go visit EFCC Headquarters for Abuja.

 

Remember se Yahaya Bello bin don dey run from EFCC since him comot from office for January 2024, after him complete him two terms of eight years.

 

Justice Emeka Nwite of di Federal High Court for Abuja bin don adjourn proceedings for di case of alleged eighty-billion-naira money laundering wey di EFCC file against Bello due to him repeated absence for court.

Posted in Politics, Trending.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *