EFCC don convince court to jail 2 internet fraudsters for Port Harcourt

Di Federal High Court for Port Harcourt, Rivers State don convict and sentence two internet fraudsters to two years for prison each.

Di convicts na Emmanuel Wisdom and Donald Etege wey dem carry go before di court for allegation of impersonation and obtaining of money under false pretense.

Di Economic and Financial Crimes Commission tok sey Emmanuel Wisdom fake him name as Sam Freidrich come take am dupe one Tony Grozdan for money wey reach one thousand, two hundred dollars as investment for cryptocurrency trade.

As for Donald Etege, di EFCC dey accuse am for sey him dupe Lisa Ricks one thousand, five hundred dollars under pretense of bitcoin trade.

Posted in Metro, News, Trending.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *