Country people wey suffer forced eviction and demolition of houses for Okobaba and Ayetoro communities in Lagos State dey demand enforcement of their right to housing, as dem dey struggle with life for open space under harsh weather conditions.
Lasgidi FM’s tori person tok with some of di victims for their gathering for Ogba area of Lagos State, as them gather to make their demand, and them come dey remember how di government demolition people take them by surprise.
Di people, including one mama with her small pikin, wey say na outside and under bridge them dey sleep since, tok say them been no expect the action, as government people been tok say na only the sawmills for Okobaba and Ayetoro go dey affected.
Lasdidi FM tori person also hear from BETTY ABAH of CEE-HOPE nongovernmental organisation wey dey help people wey dey suffer for housing matter, say the United Nations don show interest for the plenty cases of forced evictions and demolition of house for inside Naija.
BETTY ABAH tok say CEE-HOPE collect letter from di UN Special Rapporteur on Housing Rights, and dem don dey study the situation, including the plenty demolitions for inside Lagos State, and dem go soon send their report to the organisation.
ABAH say dem expect the UN to mount pressure for Nigerian authorities, including di Lagos State Government, to stop to destroy people houses without say dem follow the right procedure under the UN conventions, wey require proper engagements plus compensation of victims.
BETTY ABAH maintain say dey must make sure say Nigerian authorities see housing as fundamental right of country people and stop forced evictions and demolitions.
For him own tok, Comrade GBENGA KOMOLAFE for di Federation of Informal Workers’ Organizations of Nigeria tok say him dey aware say Lagos State Government don mark about thirty-three settlements for demolition.
KOMOLAFE come dey remind di Lagos State Government say no body chose to live for settlements wey no food, but na condition forced them to stay there, but to by force commot through evictions and demolition, that one na violation of their housing right.