30 Suspects Dey Face NDLEA Investigation for N4.4b Cocaine Inside Ethiopian Airline Plane

Di National Drug Law Enforcement Agency tok say him operatives don find cocaine of over four-point-four billion naira inside Ethiopian Airlines plane.

 

NDLEA tok-tok person, FEMI BABAFEMI, tok for inside press release say them hide di hard drugs inside toilet of the plane, wey be say enter di Murtala Mohammed International Airport for Lagos from Addis Ababa, Ethiopia, on Tuesday last week, October 29, 2024.

 

FEMI BABAFEMI still tok say di cocaine dem wrap am inside nine polythene bags wey dem hide for inside di waste collectors for di two back toilet for the plane.

 

BABAFEMI say NDLEA detectives don identify at least thirty suspects dey currently answer questioned about their roles for di smuggling of di hard drugs into Naija.

 

Him say di polythene bags wey dem find for the plane toilet contain total of eight hundred and forty-fie wraps of cocaine, wey together weigh eighteen-point-seven-two kilograms.

 

Di NDLEA tok-tok person say investigations so far don show say di seized drugs dey smuggled from Brazil by ingestion before them excrete am for Addis Ababa, Ethiopia by the smugglers.

 

Him say other traffickers bin attempt to smuggle di cocaine consignment enter Naija through di Lagos airport before the NDLEA come burst their plan.

Posted in Metro, News, Trending.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *