IGP Egbetokun Don Join Other Police Chiefs for 97th Interpol General Assembly for UK

Di Inspector General of Police, Kayode Egbetokun don travel go United Kingdom where em go join other police chiefs from around di world for di 97 general assembly of di International Police Organisation-Interpol.

 

Heads of police agencies and police chiefs from di 196 Interpol member countries dey attend di general assembly wey bi se go focus on advancing global networking for better policing.

 

Force Public Relations Officer, Olumuyiwa Adejobi tok se Nigeria Minister of Police Affairs, Senator Ibrahim Gaidam and di Vice Presido of Interpol Africa, AIG Garba Umar go still attend di Interpol event.

Posted in Crimes, News, Trending.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *