Oga Presido Bola Tinubu don swear in 7 of him new ministers wey dem screen and confirm for Senate last week.
Di new ministers na Nentawe Yilwatda, wey be di new Minister of Humanitarian Affairs and Poverty Reduction; Muhammadu Dingyadi wey be di new Minister of Labour and Employment.
Inside di list na still; Minister of State Foreign Affairs, Bianca Odumegwu-Ojukwu; Minister of Industry, Trade and Investment, Jumoke Oduwole and Minister of Livestock Development, Idi Maiha.
Others are Yusuf Ata as Minister of State for Housing and Urban Development; and Suwaiba Ahmad na di new Minister of State Education.
Presido Tinubu appoint di 7 new ministers after major shakeup for him cabinet wey see di sacking of 5 ministers and di reassignment of 10 other ministers to other roles.
Presido Tinubu perform di swearing in of di new ministers for di Council Chambers of di Presidential Villa for Abuja.