Presido Bola Tinubu don order for di release of all di di children wey dem arrest during di nationwide ‘EndBadGovernance’ protests for August dis year.
Dis na after Justice Obiora Egwuatu of the Federal High Court for Abuja grant di children wey dem arrest for Kaduna, Abuja, Gombe, Jos, Katsina, and Kano states, bail last Friday in di sum of 10million naira each.
Presido Tinubu give dis order as condemnation dey follow di arraignment of di children of between ages 12 and 15 on charges of terrorism, attempted coup and mutiny.
Na di Minister of Information and National Orientation, Mohammed Idris announce di intervention of di Presido when him dey brief reporters for di State House for Abuja.
Idris tok se di Presido order di immediate release of di minors notwithstanding di charges wey dem knack dem or di legal processes wey dey involved for di handling of di case.
He tok se di Presido still direct di Ministry of Humanitarian Affairs and Poverty Reduction to see to di welfare of di children, and make sure se dem smoothly reunite with their parents or guardians.