HOR Dey Investigate Some Ministries for $2B Renewable Energy Money

Di House of Representatives don start to dey investigate di way wey some ministers tek handle public funds.

 

Di people wey suppose show face before di House Committee on Renewable Energy na di Minister of Agriculture and Food Security, Abubakar Kyari.

 

Odas na di Minister of Science, Technology, and Innovation, Uche Nnaji and di Minister of Budget and Economic Planning, Atiku Bagudu.

 

Chairman of di House Committee, Afam Ogene of Ogbaru Federal Constituency for Anambra State, tok sey them dey investigate money wey pass $2b for development of renewable energy for Nigeria since 2015.

Posted in Business, News, Trending.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *