Di Independent National Electoral Commission don give accreditation to one hundred and eleven organisations to put eye on top di governorship election wey go happen for Ondo State for November 16, 2024.
INEC come also tok say e don approve three thousand, five hundred and fifty-five election observers, plus seven hundred journalists to shine eye for the election, wey go happen eight days from now.
INEC Chairman, Professor MAHMOOD YAKUBU yarn this update on top preparations for the Ondo State election, inside meeting wey him do with stakeholders for the state capital, Akure.
Professor YAKUBU sef talk say INEC go follow deploy Bimodal Voter Accreditation System (BiVAS) machines, for polling units’ accreditation and to forward election result on top the online Result Viewing Portal, IREV.
Di AIG wey dey in charge of Zone 17, ABIODUN ASABI, wey represent the Inspector General of Police KAYODE EGBETOKUN, confirm say twenty-two thousand, two hundred and thirty-nine police officers go hold ground for di election security for Saturday next week.