TCN Tok Say Increase of Frequency Na Him Cause Thursday Collapse of National Grid

Di Transmission Company of Nigeria talk say their engineers dem dey on top the matter to revive the national grid after the last time wey e collapse on Thursday, come put Naija people inside national darkness.

 

Di TCN yarn say na the sudden rise for frequency wey bin go high from 50.33Hertz go reach 51.44Hertz say na im cause di kasala for the latest collapse of the national grid.

 

TCN tok-tok, NDIDI MBAH, tok say collapse of di grid for di second time for three days, bin start for around 11:29am for Thursday morning.

 

MBAH talk say dem don start sharp-sharp work to repair plenty problem for di national grid, say dem go find solution as dem take restore Abuja own within 24 hours.

Posted in Business, News, Trending.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *