Di Federal Government don dey give free Cesarean Section for women wey carry belle, so dem go fit improve the healthcare, and come reduce di rate wey newborn pikin dem mama dey die during childbirth for Naija.
Di Coordinating Minister of Health and Social Welfare, Professor Muhammed Pate, na him yarn this one for the ‘Naija Health Sector-Wide Joint Annual Review for Abuja’.
Professor Pate tok on top this matter for him post for X.com handle wey be for Federal Ministry of Health and Social Welfare, say no woman supposed to die, sake of say she no get money for C-Section operation.