NDLEA Don Burst Cross-Border Drugs Trafficking Gang, Arrest 6 Nigerian and Cameroonian Suspect

Di Nigerian National Drug Law Enforcement Agency, NDLEA, don arrest six suspects for drug trafficking gangs after dem operatives raid two major cross-border gangs wey dey operate between Nigeria and Cameroon.

 

NDLEA tok-tok person, FEMI BABAFEMI, say di drug kingpins wey dey detention them from Adamawa, Anambra, Lagos state, plus three from Cameroon.

 

FEMI BABFEMI tok say NDLEA operatives recover plenty Cocaine and opioids wey cost billions of naira from di suspects.

 

BABAFEMI tok say di names of the suspect na: NELSON ANAYO, EZEH MARTIN, ADEJUMO ISHOLA, IBRAHIM BAWURO, NAJIB IBRAHIM, and IBRAHIM UMAR.

 

Him say NDLEA investigations show say di drug gangs na dem be major suppliers of hard drugs to terrorist groups wey dey operate for Naija and Cameroon.

Posted in Crimes, Metro, News, Trending.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *