De Governor of Taraba State, AGBU KEFAS don approve de payment of new minimum wage of seventy thousand naira for civil servants dem for de state.
Governor AGBU KEFAS tok say workers for Taraba State Civil Service go start to dey enjoy di new minimum wage from de payment of their salaries for this month of November, 2024.
De State Head of Service, PAUL MAIGIDA, wey confirm dey approval for press release, tok say de implementation of de new minimum wage na based on commitment of de administration to address welfare and expectation of workers dem for Taraba State.