President of di United Arab Emirates (UAE), Sheikh MOHAMED BIN ZAYED AL NAHYAN, don accept invitation from President BOLA TINUBU to visit Nigeria later this year.
This na according to one statement wey di president’s spokesman, BAYO ONANUGA, release.
Di invitation happen after both leaders dem hold tok for di Abu Dhabi Sustainability Week 2025.
President TINUBU land for Abu Dhabi on Sunday as UAE President guest, and e participate for di forum wey dey promote sustainable development and try solve global challenges like climate change and energy wahala.
ONANUGA tok say, for their tok tok, Sheikh AL NAHYAN bin say di UAE go continue to increase economic cooperation with Nigeria.