Nollywood actor Kunle Remi and im wife Tiwi don welcome dia first pikin, one baby boy wey dem name Eemi Oluwa.
Di couple share di emotional journey wey lead to dia son birth, reveal say dem face plenty challenges, including one tough medical discovery, long bed rest, and 80 days of faith-filled visits to di neonatal intensive care unit (NICU).
Kunle Remi post video of himself, im wife, and dia newborn with di caption:
“From an unexpected and unsettling medical discovery… to complete bedrest. From juggling demanding work schedules… to hopping on flights, both locally and internationally.”
Di couple tie di knot for January 2024 for one star-studded event wey big celebrities like Sharon Ooja, Ini Dima-Okojie, Deyemi Okanlawon, Omowunmi Dada, and Stan Nze attend in grand style.
View this post on Instagram