Nigerian actress, Lilian Afegbai, don call out her Lagos-based friend wey dey sell her wedding aso ebi in dollars.
For Instagram post wey she drop on Wednesday, di actress talk say she shock when she see say di aso ebi fabric wey dem give her to buy cost $1,200.
Afegbai express disbelief and talk say Nigerian brides don dey “do too much” with di way dem dey sell aso ebi.
She say, “Una don dey sell aso ebi in dollars for Lagos? Na so una wan dey sell for una wedding now? Una don dey overdo.”
She explain say after her friend send her wedding invitation, she happily congratulate am and check di date to confirm say e no clash with her schedule. Na so she come check di price and see 1200. At first, she think say na Naira, come even wonder if dem dey do giveaway.
But when she check di link well, she see say na dollars dem take write di price, and e shock her. She come convert am, $1,200 times ₦1,600, and she shock say di money run enter millions.
She ask, “For your own wedding and your I do? Na my I do? E no good, make everybody calm down. Life still dey after wedding.”