Aina Na One of Di Fastest Players Wey I Don See – Ndidi

Aina Na One of Di Fastest Players Wey I Don See – Ndidi

Super Eagles midfielder Wilfred Ndidi don hail Nottingham Forest defender Ola Aina, say na one of di fastest players wey e don ever see.

For one interview with DEEV, Ndidi talk say di Nigerian international dey perform well for both club and country.

E still yarn say Aina na one of di sharpest players wey e don ever come across.

Ndidi talk:
“Ola Aina, Mohammed Salah, and I go add Alex Iwobi. Maybe na because dem be Nigerians, but Ola Aina get better character.

“E too dey amazing. Na that kind person wey no dey give anybody wahala. No be say e no get problem, but e sabi use him vibe and personality take make people relax, and e dey do well.

“I feel say na one of di fastest players wey I don ever see. E no dey look am for body, but e too quick,” Ndidi talk.

Posted in Sports, Trending.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *