Di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) don carry Ezekiel Onyedikachukwu, wey be former manager of gospel musician Mercy Chinwo, go court over alleged money laundering wey reach $255,446.
Dem carry Onyedikachukwu, wey people sabi as EeZeeTee, and im company, Eezee Global Concepts Limited, go Federal High Court for Lagos for amended seven-count charge wey concern foreign exchange business without proper license.
Before now, EFCC accuse am say e mismanage Mercy Chinwo money, but dem later change di charge to say e do forex transactions illegally and no report im company income as law require.
Di EFCC lawyer, Bilikisu Buhari-Bala, tell Justice Chukwujekwu Aneke say for June 2023, di accused person, wey no be CBN-licensed forex dealer, do $52,895 transaction with one Mr. Oladotun Olaobaju Mureke — wey violate law.
Dem also talk say between 2022 and 2023, EeZeeTee do more forex deals without permission and no report money wey enter im company account — wey be $255,436 total.
EeZeeTee plead not guilty.
Di EFCC ask make court keep am for correctional centre, but im lawyer, Chikaosolu Ojukwu (SAN), beg court make dem give am bail as e get two sick children and na only am dey take care of dem. He also talk say EFCC and dem dey try settle the matter out of court.
EFCC no gree. Dem talk say EeZeeTee don dodge arrest before and still get court warrant hanging on top im head.
But di lawyer argue say EFCC no get proof say dem invite am and say di man show up voluntarily for court.
Justice Aneke come adjourn di bail ruling go May 9, 2025. Meanwhile, he order say make dem release EeZeeTee to im lawyer.
After court session, EFCC officers try rearrest EeZeeTee for court gate, but dem later allow am go in peace.
Count one accuse am say in June 2023, he do illegal forex of $52,895 with one Mr. Oladotun without CBN license.
Count two accuse am say in March 2021, he do another illegal forex of $70,000 with Avalan Chetrase 13 07 Company.