JUSTIN WELBY don resign as Archbishop of Canterbury for England due to pressure from abuse scandal wey happen from 2013.
JUSTIN WELBY tok for inside press release say him resign with di permission of His Majesty King CHARLES of England.
He come tok day di Makin Review report bin expose di long-maintained conspiracy of silence about very bad abuses of JOHN SMYTH.
WELBY say when them tell am about the bad things wey JOHN SMYTH been dey do for 2013 and him hear say them don report di mata for police, him believe say them go handle the mata well, but that one no come happen.
As e be like that, JUSTIN WELBY say him must take personal and institutional responsibility for di long period of painful abuses between 2013 and 2024.