Assembly Wahala: Supreme Court Don Stop CBN, Accountant General From Release Money Give Rivers Govt

Assembly Wahala: Supreme Court Don Stop CBN, Accountant General From Release Money Give Rivers Govt

Supreme Court Don Block CBN, Accountant General Make Dem No Release Money Give Rivers Gov Until Dem Obey Court Order

Supreme Court don put stop for Central Bank of Nigeria (CBN), Accountant General of the Federation, and other agencies make dem no release funds give Rivers State Government until dem clear di wahala wey court say na disobedience to court order.

For one hour, thirty-six minutes judgment wey Justice Emmanuel Akomaye deliver, di five-man panel wey sit for di matter dismiss di cross-appeal wey Governor Siminalayi Fubara file wey dey challenge di legitimacy of di House of Assembly wey Martin Amaewhule dey lead as Speaker.

As dem dismiss Governor Fubara case, di court order say Martin Amaewhule must resume sitting immediately with di other elected members of di Rivers State House of Assembly.

Di court talk say e no make sense as Governor Fubara go present budget before just four lawmakers, come deny twenty-eight other constituencies their representation. Dem talk say di thing wey Fubara do na clear disobedience to court order wey don already tell am make e re-present di 2024 budget before di properly constituted Assembly wey Amaewhule dey lead.

Supreme Court still talk say di way wey Governor Fubara take handle di alleged defection of twenty-eight lawmakers for Rivers Assembly na like say e wan use force take stop di House from doing dia work under Amaewhule leadership.

Posted in Politics, Trending.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *