Before Ayra Starr become popular, di Nigerian singer wey im real name be Oyinkansola Sarah Aderibigbe, don be social media troll.
Di 22-year-old singer reveal say she get one page wey she dedicate to Nicki Minaj, di rapper.
She talk dis one for di I Said What I Said podcast wey Feyikemi Abudu and Jola Ayeye dey host.
“I get troll page, I get Nicki Minaj fan page before I become Ayra Starr,” she talk.
Since she blow, Ayra Starr don dey talk openly about online trolls wey dey bully her.
People don troll her many times because of di kind clothes wey she dey wear and di way she dey pose for pictures. One time, she reply dem say her “bad postures” na because di weight of carrying Afrobeats singlehandedly too much.