Bisola Ajimobi Kola-Daisi, di first pikin of di former governor of Oyo State, late Abiola Ajimobi, don die.
Tori wey reach us be say Bisola, wey marry Mr. Kolapo Kola-Daisi, die for di early hours of Thursday. She die at di age of 42.
Our correspondent learn say she die for United Kingdom.
Before she die, she bin dey work as Special Adviser to di Minister of Budget and Planning, Atiku Bagudu.
Di Special Adviser to di former governor, Mr. Bolaji Tunji, don confirm di news give journalists for Ibadan on Thursday.
Tunji talk say, “Yes. E don confirm.”