Two police officers don die for one attack wey Boko Haram carry out for one police station inside Gajiram, Nganzai Local Government Area for Borno State.
Dem tok say One other officer bin sustain serious injury when di terrorists start to dey fire di police officers wey dey on duty for di station. But dem finally overpower di attackers with di help of some civilian joint taskforce.
According to di statement from Borno State Police Command’s Public Relations Officer, Kenneth Daso, dem find some bomb when dem check di area after di attack.