United States of America Presido Joe Biden don thank di Nigerian government for se dem drop do charges of money laundering and foreign exchange against American citizen and Binance Holdings senior executive, Tigran Gambaryan. Dis na afta Justice Emeka Nwite of di Federal High Court for Abuja strike out di […]
Continue readingTrending
EFCC don convince court to jail 2 internet fraudsters for Port Harcourt
Di Federal High Court for Port Harcourt, Rivers State don convict and sentence two internet fraudsters to two years for prison each. Di convicts na Emmanuel Wisdom and Donald Etege wey dem carry go before di court for allegation of impersonation and obtaining of money under false pretense. Di Economic […]
Continue readingDangote dey Accuse Retailers of se dem dey Ignore Fuel from him Refinery.
Chairmo of Dangote Group, Aliko Dangote don blame retailers for di current fuel scarcity for di country sake of se dem never begin dey buy from him refinery. DANGOTE tok se na ova 500 million litres of fuel stored for him tank farm wey dey ready for di market, but […]
Continue readingNNPCL don Raise Fuel Price to N1025 from N998 inside Lagos State
E neva reach three weeks afta fuel price jack up to ₦998, the Nigerian National Petroleum Company Limited don adjust pump price of petrol for inside Lagos to ₦1, 025. Observation dey show se NNPCL outlets dey sell one litre of petrol for ₦1,025, from the ₦998 wey e […]
Continue readingEFCC say YAHAYA BELLO Still Be Wanted Man, After Fmr Kogi Governor Claim Say Him Don Surrender
De Economic and Financial Crimes Commission don tok say former governor of Kogi State, still be wanted man for N80.2b money laundering. EFCC tok-tok person, DELE OYEWALE say dem never see YAHAYA BELLO dem office Abuja, and de case of money laundering still dey ground. Dis tory burst […]
Continue readingINEC Don Deny Julius Abure as Labour Party National Chairman
Di Independent National Electoral Commission no gree sabi Julius Abure na di National Chairmo of di Labour Party. INEC declare im position for inside counter affidavit wey im fill to respond to case by Julius Abure-led National Working Committee of LP for di Federal High Court for Abuja. Abure want […]
Continue readingUS Hip-Hop Bigboy, Sean ‘Diddy’ Combs Appear for Court for Sexual Offences
American hip hop music mogul Sean Diddy Combs don dey face charges of racketeering, by force sex trafficking, fraud and transportation to go do prostitution. US federal Prosecutors drag Diddy go before one court for New York ontop allegations say him use him business empire to dey threaten, violently assault and […]
Continue reading11 Southern States Don Get Flood Alert, As Cameroon Begin Release Water from Lagbo Dam
As dem don release water from Lagbo Dam for Cameroon, Federal Govment don put eleven states for di southern parts of Naija on flood alert. Di States wey dis one concern na states wey dey share borders with di Benue River, like Adamawa, Taraba, Benue, Nasarawa, Kogi, Edo, Delta, Anambra, […]
Continue readingNAFDAC Don Expose Factory for Fake Cosmetic Products For Lagos Trade Fair Complex
Di National Agency for Food and Drugs Administration and Control don close down one factory for Trade Fair Complex for di Lagos Badagry Expressway sake of se dem dey produce fake cosmetic products. NAFDAC operatives, wey go burst the illegal factory for Benue Plaza for Trade Fair Complex discover plenti […]
Continue readingUS FBI don arrest music bizman, SEAN “DIDDY” COMBS
FBI agents for US don arrest music businessman, SEAN “DIDDY” COMBS for New York. Reports tok say FBI detains DIDDY for Manhattan for some kind accusation wey dem never tok for public. DAMIAN WILLIAMS, wey be de United States Attorney for Southern District of New York, na him […]
Continue reading