De govment for Mali don order to close de airport for de capital, Bamako, after dem hear gunshots and explosions inside military base for the area. AFP news agency report say dem never identify armed men do de attack for de military police base for Bamako. As that one happen, […]
Continue readingTrending
Lagos State Gorment say Oko Baba plank market fire affect illegal occupants
Di Lagos State Gorment don tok se di pipu wey di recent fire outbreak for Oko Baba plank market affect dey stay di area illegally. Di plank market wey fire breakout dey for Ebute Metta area of Lagos State. Di Commissioner for Information and Strategy, Gbenga Omotoso tok dis one […]
Continue readingUAE donate 50 tonnes of basic humanitarian supplies for victims of flood disaster insideNaija
Di United Arab Emirates don donate fifty tonnes of humanitarian supplies to take support victims of flood disasters in Nigeria. Large portion of di UAE relief supplies go go to di victims of di massive flood disaster for Maiduguri, Borno State. When di reach airport, di UAE Ambassador to Nigeria […]
Continue readingPresido TINUBU don visit Maiduguri, Borno State to see victims of di flood disaster.
Oga Presido Bola Ahmed Tinubu don enter Maiduguri, Borno State, to go see things for himself sake of di flood disaster in di area. Di Nigerian Air Force plane wey fly Oga Presido Tinubu touched down for di airport for Maiduguri for afternoon of Monday, as Governor BABAGANA ZULUM […]
Continue readingUS Police detain RYAN WESLEY ROUTH sake of attempted assassination of before Presido DONALD TRUMP
Authorities for di United States of America don start to dey investigate attempted assassination of former Presido and presidential candidate of di Republican party, Donald Trump for Florida. Di latest case just dey happen two months after Oga Trump been survive shooting for him campaign rally for Pennsylvania. […]
Continue readingLP Crisis: JULIUS ABURE drag INEC go court to reject Caretaker Committee of NENADI USMAN
Di National Working Committee of the Labour Party wey Julius Abure dey lead don drag di Independent National Electoral Commission go court. Abure with him NWC members want make di Federal High Court for Abuja stop INEC to recognise di caretaker committee wey sentor Nenadi Usman led. Remember […]
Continue readingDangote Refinery deny NNPCL claim se dem sell petrol for N898per litre.
Di management of Dangote Petroleum Refinery don deny se NNPCL dey claim se dem sell petrol for N898 per litre as take-off price. Di Chief Branding and Communications Officer of the Dangote Group, Anthony Chiejina tok se NNPCL claim dey mislead but dem no even comfam the main price of […]
Continue readingNNPCL don tok say dem buy Dangote Refinery petrol for N898.78k
Nigerian National Petroleum Company Limited tok se dem go sell petrol wey dem buy from di Dangote Refinery for N950 per litre for filling stations in Lagos. Na di Chief Corporate Communications Officer Olufemi Sonaye naim release di informat for statement on top Estimated Pump Prices of PMS from […]
Continue readingEFCC declare IBRAHIM MOHAMMED wanted for sake of say him thief dia motor
Economic and Financial Crimes Commission don declare one IBRAHIM MOHAMMED wanted for say him thief dia motor. EFCC tok-tok person, DELE OYEWALE, write for inside statement say 26-year-old MOHAMMED na from Jada Local Government Area of Adamawa State. OYEWALE no come explain de kind motor wey him allegate […]
Continue readingMaiduguri Flood: FG say Alau Dam no collapse
De Federal Government don tok say no be collapsed dam cause de heavy flood for Maiduguri, Borno State. Instead, de Minister of Water Resources and Sanitation, JOSEPH UTSEV, tok say na too much water from Ngadda River wey overflow de Alau Dam. UTSEV wey dey brief tori people […]
Continue reading