After plenty months of delay, NYSC corpers fit get reason to smile as Federal Government don promise say dem go pay di backlog of di new ₦77,000 monthly allowance.
Di Federal Government bin increase corpers’ allawee from ₦33,000 to ₦77,000 for September 2024, but since di announcement, di new rate never start to dey enter account, despite plenty promise and backlash.
But now, di corpers wey still dey serve plus those wey dey inside di scheme when dem announce di increase for September 2024 go collect di back pay.
Minister of Youth Development, Ayodele Olawande, give di assurance for one interview.
“You see say di new DG talk say una go get am, and dem dey ask am, ‘Wetin go happen to those wey go soon pass out, dem go still collect am [backlog]?’ He say ‘We get una details.’”
Di minister come add: “Di backlog, we go work on am and make sure say dem pay una. E fit no quick happen, but e go surely happen.”
READ ALSO: Corpers Allowance Go Cost NYSC N307.6bn After Minimum Wage Review