Chief Magistrate Court for Wuse Zone 6, Abuja, don issue bench warrant make dem arrest blogger Martins Vincent Otse, wey people sabi as VeryDarkMan (VDM), sake of say e allegedly spoil gospel singer Mercy Chinwo name.
Di magistrate don order Nigeria Police Force plus other security people make dem carry VeryDarkMan come court make e answer di allegations wey dem put for e head.
Magistrate Emmanuel Iyanna give di order on Thursday, March 13, 2025, after VDM no show for court despite say dem summon am since March 5, 2025. Even as e lawyer, Deji Adeyanju, beg magistrate make e cancel di warrant, di magistrate stand gidigba say dem must bring am by force.
Adeyanju tell Channels Television say: “Yes, dem don issue bench warrant against am because e no show for court. But na just media trial dem dey do, dem no really wan prosecute di matter.”
Di matter dey related to wetin VDM talk for social media, where e accuse Mercy Chinwo of diverting $345,000 wey dey linked to her former record label boss, Ezekiel Onyedikachukwu (Eezee Tee). Mercy Chinwo don carry email and payment receipts go court to prove say di allegations no get head or tail and e don damage her reputation.
Her lawyers, led by Pelumi Olajengbesi, tok say wetin VDM do dey against Sections 391 of di Penal Code and Section 24(1)(B) of di Cybercrime Act 2015.
No be only di criminal case Chinwo carry go court. She still don sue VDM for Federal High Court, Abuja, dey find N1.1bn damages and don demand say make e delete, retract, and apologize for all di bad talk wey e don yarn against her.