Di management of Dangote Petroleum Refinery don deny se NNPCL dey claim se dem sell petrol for N898 per litre as take-off price.
Di Chief Branding and Communications Officer of the Dangote Group, Anthony Chiejina tok se NNPCL claim dey mislead but dem no even comfam the main price of di product.
Chiejina tok se di statement wey NNPCL release dey downgrade di recent milestone wey Dangote Group don achieve to tek address Nigeria long standing energy crisis.
He dey let Nigerians know se make dem wait for Dangote formal announcement on petrol pricing wey be se na di Technical Sub-Committee on Naira-Based Crude Sales to Local Refineries.