EFCC tok-tok person, DELE OYEWALE, say na operatives of de Lagos Zonal Directorate carry out de raids inside Adewale Estate and Sea Side Estate for Badore.
OYEWALE tok say de suspects wey dem identify as members of an Organised Cybercrime Syndicate Network, commit computer-related fraud.
Him still tok say items wey dem recover from them include some expensive cars, and mobile phones, come still tok say de suspects dem don give their statements, and dem go charge dem go court after investigation.