Popular businessman E-Money don finally talk after EFCC release am from their custody.
Dem bin arrest am on Monday night based on say he dey spray US dollars, wey no follow di Foreign Exchange Act.
For one Instagram video, E-Money thank everybody wey support am. He talk say, “No tension, everywhere good,” and he pray make God bless all him supporters.
He still add say, “I see all una love and support. God bless una. #itistoolatetofailmen.”
View this post on Instagram