Manchester United co-owner, Sir Jim Ratcliffe, don blast di club decision to replace Sir Alex Ferguson with David Moyes.
For interview wey im do with The Times, Ratcliffe yarn about di decisions wey di previous United management take.
Ferguson comot for 2013, and dem put Moyes, wey be im fellow Scotsman, to replace am.
Ratcliffe don now question why dem pick Moyes, wey no get trophy experience and never manage top players before.
E talk say: “See, I like David Moyes, and I feel say e be really good manager, but to move from Sir Alex Ferguson to Moyes no be wetin I for do.
“Moyes enter Ferguson shoes – person wey don win Premier League 13 times, Champions League two times – and dem hand di job give pesin wey never manage big players before and never win anything.
“He no even get di kind personality wey fit stand for front of dem all.”