EPL: Paul Merson Dey Worry, E No Happy With Chelsea Matter

EPL: Paul Merson Dey Worry, E No Happy With Chelsea Matter

Former Arsenal midfielder Paul Merson don talk say e dey fear as Chelsea dey go for di 2024-25 Premier League season, especially after di way dem take fall out for FA Cup.

Merson no happy as Chelsea lose 2-1 to Brighton last weekend, even after dem first score. E talk say di team no get consistency, and e fit affect dem as dem go play their next Premier League match for Stamford Bridge.

One of di big wahala wey Merson see na say Chelsea no go get their striker Nicolas Jackson wey don woundjure. E talk say Jackson absence go affect di team attack, especially Cole Palmer, wey sabi play well when Jackson dey around.

“I no happy with Chelsea last weekend. Dem first score against Brighton for FA Cup but still lose di match. Na so dem just fall out for fourth round!” Merson tell Metro for him match preview.

E still yarn say even though some fans dey complain about Jackson, dem go now see how important di striker be for di team.

“Nicolas Jackson no go play because of injury, and e go really affect Chelsea. Some fans dey talk say make di club buy another striker, but now dem go see how much dem go miss am. Di way e dey move without ball na wetin dey make Cole Palmer play well.”

Merson still talk say di way Chelsea dey use Christopher Nkunku no go help dem, because Nkunku na proper No. 10, no be striker.

“I dey fear for Chelsea top four hope now wey Jackson don woundjure. I don always talk say Nkunku no be main striker, and if dem use am for dat position, e no go work well.”

E still add say Brighton no get pressure, and dem fit still shock Chelsea again.

“I go surprise if Chelsea win dis match. I dey even reason say di same tin wey happen for FA Cup fit repeat itself.”

Right now, Chelsea dey for fourth position for league table with 43 points, but if dem mess up, Manchester City fit overtake dem if dem win Newcastle United dis weekend.

 

Posted in Sports, Trending.