EPL: Pochettino Admit Say E Wan Return To Im Former Club

EPL: Pochettino Admit Say E Wan Return To Im Former Club

Di head coach of di US national team, Mauricio Pochettino, don admit say e go like return to Tottenham Hotspur one day.

Di 53-year-old coach bin dey in charge of di North London club between 2014 and 2019.

Under am, Spurs finish second for Premier League for 2016, reach di 2015 EFL Cup final and di 2019 Champions League final.

But dem sack am for November 2019 before e later go manage Paris Saint-Germain and Chelsea.

Pochettino become United States coach for September.

“When I commot for di club, I remember say I talk for one interview say I go like come back to Tottenham one day,” di Argentine tell Sky Sports.

“I dey USA now, so I no go talk too much about am – but wetin I talk dat time, even after five or six years, e still dey my heart. Yes, I go like come back one day.”

Pochettino still talk say e still get “very good relationship” with Spurs chairman, Daniel Levy, even after dem sack am.

Posted in Sports, Trending.