Calvin Bassey no fit hide im joy after e score for Fulham as dem knack Manchester United for Emirates FA Cup match wey happen for Old Trafford on Sunday. Di Nigerian international open di scoring just before halftime, as e use im head nak di ball past United defense, wey make am im first-ever goal for dis prestigious competition.
Di match bin dey tight as Bruno Fernandes equalize for di home team with 19 minutes remain for normal time. But Fulham keep dem composure for penalty shootout, come win Manchester United 4-3 to secure di victory.
As e dey yarn with BBC, Bassey talk say e dey grateful and happy: “E be privilege and honor to play for dis kind big stadium. To come play for place like dis na blessing, and I dey very thrilled.”
As e reflect on di goal, e add: “I like to think say I get poacher’s instinct. I just try predict where di ball go land, run pass di defense, and use my head put am for net.”
Bassey still hail Manchester United say dem be strong team: “Dem get plenty talent and skill. Our game plan na to slow down di tempo and hold ball well, and e work for us at di end.”