Di Federal Government tok sey di ruler of di Kingdom of Saudi Arabia dey praise President BOLA AHMED TINUBU for him economic reform policies.
Dis na part of wetin come out of Oga President TINUBU visit to Saudi Arabia for di joint Arab-Islamic Summit wey focus for di crisis for Middle East, where Oga Presido present Nigeria position for peaceful settlement through two-state solution.
Na Special Adviser to di President ontop Media and Publicity, BAYO ONANUGA tok sey di Saudi Crown Prince, Prince MOHAMMED BIN SALMAN BIN ABDULAZIZ AL SAUD still assure di Nigerian Government of him support for di ongoing economic reform programmes.
ONANUGA tok sey di Crown Prince wey dey double as Prime Minister of Saudi Arabia give di assurance during by di time of him meeting with Oga President TINUBU for Riyadh, for di sideline of di joint Arab-Islamic Summit.
Him tok se di two leaders discuss possible areas for cooperation wey go cover oil and gas, agriculture, infrastructure and setting up of di Saudi-Nigeria Business Council.
BAYO ONANUGA still tok sey di Nigerian Government dey expect to seal agreement with di Saudi Government for proposed five billion-dollar bilateral trade facility between di two countries.