Fire don burn some parts of Onitsha Main Market for Anambra State, Nigeria.
Di fire start for one building around 6:20am and e don spread enter another building. For now, di cause of di fire never clear.
People wey dey around, including residents, passersby, and fire service officials, don dey try save some property and goods from di burning buildings.
Di Head of Media and Publicity for Anambra State Fire Service, Chukwudi Chiketa, confirm di incident for one short message on Friday.
E beg di public make dem stay calm as firefighters dey try quench di fire.
“Anambra State Fire Service don rush go di scene of di fire for Ifejika Street, by Sokoto Road, Onitsha. Di emergency call reach us by 6:20am, and our firefighters move immediately,” Chiketa talk.
E still assure di public say di situation dey under control.