Rivers State Governor, Siminalayi Fubara, don write Rivers State House of Assembly again, propose Wednesday, March 19, 2025, as di new date wey e go present di 2025 state budget.
For di letter wey e send give di Speaker of di Assembly, Rt. Hon. Martin Amaewhule, Governor Fubara talk say e first try present di budget on March 12, but e no fit enter di Assembly premises.
E explain say, even though dem don already send soft copy notice and try submit hard copy through di clerk, dem still lock am and im people for outside.
Di governor talk say e dey follow Supreme Court judgment wey order di Assembly to do dia work inside di law.
E still remind di Speaker say di House don first give am 48-hour ultimatum to present di budget, even before dem give am certified true copy of di judgment and di enrolled orders.
Governor Fubara talk say despite di political wahala for di state, e still dey committed to governance.
E beg all di government bodies to do dia work inside di law and constitution for di good of di people.
“No matter how our wahala be, we suppose put Rivers State and di people first before political palava,” na wetin e talk.
Di letter formally tell di Speaker say e wan present di budget on March 19 by 11:00 a.m. or any other time wey di House go see say e good.
Governor Fubara talk say e hope di Assembly go gree with im request.
Since Supreme Court talk say make di governor present di 2025 budget to di Assembly wey Amaewhule dey lead, di matter don dey go front and back.
Di whole drama play out on Wednesday for di Rivers State House of Assembly Quarters, as Governor Fubara reach di venue but dem lock di entrance gate.
Di security personnel wey dey di quarters lock di gates as di governor convoy arrive.
Dem talk say dem lock di gate because di governor no officially communicate with di Assembly, but di governor insist say e don inform di lawmakers say e dey come.
On Thursday, Governor Fubara beg members of di Rivers State House of Assembly make dem think about di people interest and embrace peace to end di political wahala for di state.
“As e be now, we all need to embrace peace,” na wetin Fubara talk as e commission some projects for Okrika Local Government Area.
E talk say e need peace to fit govern di state well, and e call on all di politicians wey no happy make dem forget di past and follow di February 28, 2025, Supreme Court decision.
“Di Supreme Court don give judgment, we no get any choice but to obey am, and by God’s grace, we don start di process.
“We dey beg everybody, make una consider Rivers State interest. Di only thing wey we owe di state na peace and development.
“I dey open any day, any time for total peace for our state because if I go govern well, we need peace,” na wetin di governor talk.