The National Publicity Secretary of di All Progressives Congress, APC, Felix Morka, don support President Bola Tinubu decision to declare state of emergency for Rivers State, say di suspended governor, Siminalayi Fubara, no respect democracy.
Tori tok say afta 15 months of political wahala for di oil-rich South-South state, di President announce di state of emergency on Tuesday, 18th March 2025, for national broadcast.
Di President still use di power wey dey for Section 305 of di Nigerian Constitution, 1999 (as amended), take declare di state of emergency for Rivers State, suspend Governor Siminalayi Fubara, im deputy, Ngozi Odu, and all di Rivers Assembly members for di first six months.
Even as some people don criticise di President power to do dis kind tin, Morka talk for interview on Tuesday say opposition people no dey sincere.
E say, “All di people wey dey talk, na politics dey worry dem, dem no dey objective. If dem dey objective, dem for don call me make I explain di kind tin wey Governor Fubara dey do wey no good for democracy. Di man dey slap democracy for face wit im action.
“E neva tey wey dem elect am, e don wan change di Speaker of Rivers State House of Assembly, wey dem elect too. When im plan no work, di governor come scatter di Assembly complex, make dem no fit do any legislative work. But di same opposition people wey dey shout now, no talk anything dat time. Peter Obi no even talk when Fubara wan block di state legislature. Di man even go ahead freeze all di state money.”
As im dey defend di state of emergency, Morka tok say President Tinubu follow wetin Section 305 of di Nigerian Constitution talk, since di matter concern national security wahala and governance problem.
According to am, intelligence report show say security risk dey rise for Rivers State, especially as dem don vandalise Nigeria biggest pipeline, di Trans Niger Pipeline (TNP).
Morka still talk say di President no make di decision alone, as National Assembly later approve am wit two-thirds majority vote.
“National Assembly no be only APC or PDP or Labour Party people full am. Na all di political parties wey get representatives dey inside. All of dem check di situation well before dem approve di President decision for Rivers State.”
One part wey cause plenty argument na di suspension of Governor Fubara. Some critics, including di Nigerian Bar Association, NBA, dey talk say Section 188 of di Constitution don already show di correct way to remove governor, and dem no follow di process.
But Morka say di President no remove di governor, e just suspend am as one special action to balance di state.
E even quote Section 5, Subsection 3 of di Constitution, wey talk say governor no suppose use im power take disturb di federal government.
Morka no send di critics, as e ask why PDP governors and leaders no solve di crisis before e reach dis level. E accuse dem say dem close eye for months, but now dem dey challenge di federal government intervention.